Monday, October 17, 2011

Dis Subsidy Sef


Monday, October 17, 2011

Chidi Anthony Okpara

We dey hearam for morning,
For afternoon sef we dey hearam,
We dey hearam for night.

Dem dey halaram,
We no dey rest.

Subsidy!
Subsidy!!
Subsidy!!!
Dis subsidy sef.

Dem say na awuf money
Wey we dey chop,
Dem say na government money.

Awuf money we no see,
Government we no see,
Na so so suffer we dey.

Kidnappers dey kidnap us,
Thieves dey thief our property,
Militants dey murder us,
Better things we no dey see.

Upon dat,
Dem still dey hala subsidy,
Dis subsidy sef.

No comments:

Post a Comment